For Naija, any which way na way, but unto sey we no wan loss, we kukuma carry waka sidan for house. Who waka epp? - Stefn Sylvester Anaytonwu WHICH WAY? E don tey wey I de pray make Jah show me the way; But e be like say Jah compass no de behave. I no go shock sef if boys don move am enter Agege. Test the thing sharply hail am that other way. In Nigeria everybody even pikin has to know the way, Everybody wey you meet go talk say all way na way. I enter bank say make I withdraw my change; I jam queue wey take small thing pass my eye gauge, As I de think my life for queue de wait my turn, Two men like that just enter sharply collect their coins; People hala but the sharp guys no even budge, The important thing is that their pockets have bulged. Toh, all of us know say all way na way. My editor guy carry im lappy de go work; I been tell am the night before say im dreads no work, My guy ignore me and to his utter shock, SARS stop am the next day ask am im handwork; As baba shape mouth...